Wia dis foto come from, JUNIOR POPE/INSTAGRAM

10 April 2024, 17:58 WAT

Junior Pope - Figure 1
Photo BBC News

New Informate 18 minutes wey don pass

President of di Actors Guild of Nigeria Emeka Rollas Ejezie say ogbonge Nollywood actor Obumneme Odonwodo aka Junior Pope dey alive.

Oga Rollas confam dis for post e do on im Facebook account.

“Wetin God no fit do no exist. Junior Pope dey alive. E dey take treatment for hospital," e tok.

Earlier report bin spread say Junior Pope bin drown afta boat wey im and oda dey inside bin capsize.

Skip Facebook post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

Who be Junior Pope

Junior Pope come from Ukehe, Enugu State, and im be di sixth among eight pikin wey im parent born and dem born am for Bamenda, Cameroon.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Im papa be trader and im mama comot for Nigeria go Cameroon during di civil war.

Junior Pope attend primary and secondary school education for Cameroon, e later come back to Nigeria for university education for University of Nigeria Nsukka.

Di Nollywood actor graduate wit degree in Accounting but start to dey act feem Nollywood movies for 2006.

For 2007, e become famous afta im role for “Secret Adventures” wey Tchidi Chikere be di feem director.

E don act for ova 100 Nollywood feems such as: “Secret Adventures”, “Vengeance of Bullet”, “Di Cat”, “Mad sex”, “Bitter Generation”, “Di Generals”, “Wrong Initiation” among odas.

For 2010, im win im first award as di Most Promising Nollywood Actor from Entertainment Factory Awards.

E sabi act role wey pipo dey see am as antagonist such as criminal, villain, armed robber, militant and hitman. And e don act wit oda actors like Emma Ehumadu, Sylvester Madu, Zubby Michael, Jim Iyke, Alaso Wariboko, Gentle Jack, Hanks Anuku and Jerry Amilo.

Junior Pope marry im long-time girlfriend for 2014, Jennifer Awele, wey im meet for Facebook and she be di mama of im three boys.

For 2021, Junior Pope tank God say im and im family no die inside one fire incident wey happun for dia house for midnight.

‘‘Join Me In Tankin God Ooooooooo. My house almost catch fire while my family dey sleep. But God interven. My hands dey clean Oooooooooooo, (Akam di Ocha). God na di Greatest. My family and me dey safe,” e tok.

Skip Instagram post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Dis tori don dey updated