Bishop TD Jakes medical emergency: Update from family members ...

2 hours ago

Family members give update on Bishop T.D Jakes condition afta im medical emergency during Sunday service

T.D. Jakes - Figure 1
Photo BBC News

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One video show di preacher begin dey shake as im dey give sermon wia im microphone fall for ground bifor church leaders rush to help am for stage

25 November 2024, 09:26 WAT

New Informate one hour wey don pass

Ogbonge American preacher and motivational speaker Bishop T. D Jakes dey “stable condition” afta im get medical emergency on Sunday.

One viral video show di founder of di Potters House Church as e get medical emergency as im dey wan end im sermon.

Inside di video, di Bishop bin dey tok dis words bifor im suddenly begin to shake.

“I miss you. You don ever go hospital to visit somebody wey you say you dey go encourage dem, wia dat person rather bin dey encourage you? Na so preaching dey,” Bishop Jakes tok.

Im add say “you go tink say you dey give out sometin but you dey get back more than you give. I love you.”

“Now lord, let di words of my mouth and di meditations of my heart dey acceptable for your sight, oh lord, my strength, my redeemer, make dem go in peace.”

Di church members bin dey clap as im tok dis words.

Na afta dis tins im tok wey im begin to shake inside di chair wey im sit on for di pulpit.

As di Bishop bin dey shake, di mic fall from im hand bifor some of di pastors and leaders of di church rush to di stage to hold am, to give am support.

Since di video bin go viral, many pipo around di world bin dey comment wia dem dey pray for di Bishop.

T.D. Jakes - Figure 2
Photo BBC News

Inside one statement, di Potter’s House of Dallas church tok say “Bishop T.D Jakes bin experience slight health incident wey im get immediate medical attention afta im power sermon wey last for one hour.”

“Bishop Jakes dey stable and dey under di care of medical sabi pipo.”

Di statement add say “di entire Potter’s House family bin dey grateful for di love, prayers and support from di community.”

Hours afta di incident, di Bishop im daughter and son-in-law bin post one video wia dem give update of di condition.

Sarah Jakes wia im husband Toure Roberts dey stand by im side, tok for dat video say “na interesting day for us, but we no want go bed without updating una about everitin wey dey happun to Bishop.”

“We feel di prayers, e fit be worse if no be your prayers, but na di mercy of God, Bishop don dey recover.”

Sarah add say “Bishop dey under di care of sabi medical pipo, im dey strong, we don dey try to make am sit down, na im be di strong Bishop wey we know.”

Inside di video, Sarah wey be author, also remind pipo say “as we dey enter di holiday season, we need to love pipo wey we cherish wey and we also need to dey grateful for all di pipo God don give you.”

Skip Instagram post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Who be Bishop T.D Jakes

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Family of di 67 year-old bishop say im dey stable

Bishop Thomas Dexter Jakes apart from say im be preacher, also get oda businesses.

Di TD Jakes enterprises get branches wey dey into producing music, organizing thought leadership events and marketing consultancy.

Im also get di TD Jakes divinity school wey dey offer online education for ministry leaders - degrees and short courses.

Di preacher also dey into real estates wit TD Jakes real estate ventures LLC, as well as im charity foundation.

For di potter’s house website, tori be say Bishop T.D Jakes begin di church for 1996 as a non-denominational church.

Di church get more than 30,000 members, “e dey rank among di largest and most influential churches for di US.”

TD Jakes daughter and son in-law na assistant pastors of di potter’s house.

Sarah Jakes Roberts and im husband Touré Roberts na di first ever assistant pastors for di church in dia 28-year history.

T.D Jakes bin marry im wife Serita Ann Jamison for 1981.

Serita na speaker, author and spiritual mentor and im and T.D Jakes get five pikin

wit at least five grandchildren.

Read more
Similar news
This week's most popular news