How Spain comot host nation Germany to qualify for Euro 2024 semi-final

Wia dis foto come from, Getty Images

Spain vs Germany - Figure 1
Photo BBC News

5 July 2024

Spain shock Germany wey be host nation for di ongoing Euro 2024 afta dem beat dem 2-1 for extra time.

Germany become di first host nation wey go comot from di tournament for di quarter-final stage.

Di match no easy for di two clubs as dem play 0-0 for first half.

Spain score di first goal of di match few minutes into di first half wen Dani Olmo score for di 51st minute.

Florian Wirtz equalize for di Germans for di 89th minute.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Dis goal carry di match enta extra time. Na for di last minute of extra time Spain score di winning goal thru Mikel Merino.

Spain go face di winner of Portugal vs France quarter-final game for di semi-finals.

Wia dis foto come from, Getty Images

Spain 2-1 Germany

120+ 7 Full Time afta extra time

120+6 Dani Carvajal collect RED card for foul on im opponent.

120+ 4 Plenot action for di dying minutes of dis match.

120+4 Alvaro Morata collect yellow card.

120+3 Fabian Ruiz of Spain collect yellow card for yeye behaviour.

120’ Three minutes added time

Spain 2-1 Germany

120’ GOAL! Mikel Merina score for Spain. E just push di ball inside di net.

119’ Two minutes added time.

117’ Niclas Fullkrug get one beta cross for di edge of di box , e play di ball towards di left post but Unai Simon dive to save di ball.

114’ Deniz Undav of Germany wey dey bench sef don collect card for behaviour wey no support sports.

113’ Toni Kroos dey call for medical attention , e don get injury.

111’ Joshua Kimmich of Germany do one Yeye foul challenge but referee pity am no blow foul.

110’ Rodri of Spain don collect yellow card for foul.

108’ Ferran Torres of Spain try to send beta cross from di corner kick but di Germany defence clear di ball.

107’ E be like say Marc Cucurella of Spain hold di ball inside di box but referee turn am down say NO PENALTY!

106’ Second period of extra time don start.

105+1 First period of extra time done end.

105’ One minute added time.

105’ Florian Wirtz miss beta opportunity l, im get di ball inside si box, e fire shot but e go wide off so right post.

102’ Substitution for Spain as Luis de la Fuente need to change Fabian Ruiz e no go fit play again and Joselu don replace am.

102’ Fabian Ruiz dey feel pain, e don comot to get medical attention.

Spain 1-1 Germany

100’ Daniel Carvajal of Spain collect yellow card. Im go miss di next game.

98’ Florian Wirtz of Germany play one long ball, but e no strong reach to meet im teammates, defenders block di pass.

Spain vs Germany - Figure 2
Photo BBC News

97’ Dani Olmo of Spain strike di ball towards di post but defenders block di pass.

94’ Florian Wirtz collect yellow card for foul.

94’ Niclas Fullkrug run too much sotay e enta offside position.

92’ Ferran Torres of Spain jump inside di box to head di ball, but di header go wide off di right post.

91’ Substitutio for Germany, Kai Havertz don play finish and Waldermar Anton don enta.

91’ First period of extra time don start.

Second Half

Match don tie wrapper as e go enta extra time.

90+4 Second half don end.

90+3‘Dangerous play by Ferran Torres of Spain referee blow whistle.

90’ Four minutes added time

Spain 1-1 Germany

89’ GOAL! FLorian Wirtz score for Germany. With dis goal im don become di youngest player to score for Germany for inter tournament.

86’ Kai Havertz of Germany commit foul and refere blow whistle.

85’ Referee blow whistle as Daniel Carvajal of Spain challenge im opponent wit anger. Germany get free kick.

82’ Kai Havertz of Germany try to find space for di edge of di box e fire shot but e go over di bar.

82’ Spain goalkeeper Unai Simon collect yellow card for foul.

81’ Kai Havertz of Germany create beta chance but im attempt to pass so ball to I’m team mate no dey successful.

80’ Substitution for Germany, Jonathan Tah don comot Thomas Muller replace am.

80’ Substitution for Spain, Mikel Merino don replace Nico Williams while Alvaro Morata give chance for Mikel Oyarzabal.

77’ Chance for Germany to equalize but e hit bar. Niclas Fullkrup waste di clear chance.

74’ Ferran Torres of Spain don collect yellow card too sake of bad challenge on im opponent.

73’ Maximillian Mittelstadt of Germany wey just enta di match don chop yellow card, im go miss di next game.

71’ Kai Havertz of Germany make one effort from inside di box but Spain defenders block am.

69 ’ Beta chance! for Germany but Robert Andrich waste am. A fire do ball from mid range towards di bottom right corner but Unai Simon save am.

67’ Toni Kroos don collect yellow card sake of di bad tackle on Spain playe.

66’ Toni Kroos has f Germany commit foul sake of rough tackle referee blow whistle.

65’ Antonio Rudigrr of Germany play one long ball but Unai Simon catch di ball without stress.

63’ Toni Kroos play anoda corner kick for Germany but notin come out.

63’ Substitution for Spai, Ferran Torres don replace Lamont Yamal.

60’ Corner kick for Germany, Toni Kroos play am but defenders clear di ball.

60’ Florian Writz of Germany fire di ball from outside di box but defender block I’m attempt.

Spain vs Germany - Figure 3
Photo BBC News

57’ Gundogan don comot and Nicklas Fullkrug don enta.

57‘ Substitutio for Germany Maximillian Mittelstadt don enta for David Raum.

56’ Robert Andrich of Germany wey just enta don collect yellow card for foul.

55’ Florian Writz of Germany nearly get beta position but di thru ball wey Gundogan give am defenders block am.

51’ GOAL! Dani Olmo of Spain don scor!

47’ One short pass from Lamine Yamal put Alvaro Morata of Spain for beta position inside di box wit only di goalkeeper, but I’m shot fly go up ova di bar.

46’ Substitution for Germany , Emre Can don play finish and Robert Andrich enta for am.

46’ Substitution gor Spain, Robin Le Normand don comot and Nacho Fernandez replace am.

46’ Substitution for Germany, Leroy Sane don comot Fiorian Wirtz don enta.

46’ Referee don blow whistle and second half don start.

First Half

Half Time: Spain 0-0 Germany

45+2 Referee blow whistle , first half don end.

45+1 Lamine Yamato of Spain get one beta pass, e beat im opponent and fire one lang range shot but e no strong reach as e go towards middle of di post and Manuel Neuer catch am.

45’ Lamont Yamal of Spain play one low pass into do box wey defenders block.

45’ Fourth official show 2 minutes added time.

43’ Alvaro Morata of Spain try to find Lamine Yamal wit one beta thru ball from di corner of di box but di Germany defence balance well to clear di ball.

41’ Toni Kroos of Germany make one bad challenge and referee blow whistle for foul.

39’ Dani Olmo of Spain fire one beta shot from far towards di bottom left corner of di box but Manuel Neuer try to save am.

38’ Spain continue to hold di ball as dem dey play short short passes.

37’ Referee blow whistle for foul afta Fabian Ruiz of Spain make bad tackle.

35’ Spain goalkeeper Unai Simon save di dangerous effort wey Kai Hervertz of Germany make.

34’ Chance! Joshua Kimmich Germany pass di ball into di box but Unai Simon clear am.

33’Alvaro Morata of Spain play one - two touches but do love no dey successfu.

32’ Daniel Carvajal of Spain dey run alone wit di ball but I’m no fit create any chance as opposition defender block am.

Wia dis foto come from, Getty Images

32’ Di match dey hit as both teams no dey gree for each oda! Referee sef just dey blow whistke for foul dey share card upandan.

30’ Robin Le Normand of Spain don collect yellow card too. Im go miss dI next game if Spain qualify.

28’ David Raum of Germany won chop yellow card for bad tackl.

27’ Toni Kroos of Germany play di corner kick.

26’ Di free kick from long range wey Germany play, Spain defenders block am. Di ball enta corner. Germany go play di corner kick.

24’ Toni Kroos of Germany play di direct free kick.

24’ Alvaro Morata of Spain make one tough challenge and referee blow whistle for foul.

23’ Aymeric Laporte of Spain get one pass as I’m fire shot towards goal but do shot no get power to shake Manuel Neuer.

21’ Kai Harvertz of Germany head one beta cross towards di bottom left of di corner. Unai Simon block di attempt as im save di ball.

20’ Joshua Kimmich of Germany play di ball go front but Spain defender block am.

18’ Leroy Sane of of Germany try to play di ball towards di front of goal but Spain defender clear am.

17’ Fabian Ruiz of Spain get di ball from one beta long pass, im try to shoot from di edge of di box but notin come out.

16’ Alvaro Morata of Spain strike di ball towards goal but di ball no shake di goalkeeper at all, defenders mount for so post.

15’ Chance! Lamine Yamal of Spain okay di free kick from beta position but di ball fly some inches wide to di right post.

14’ Antonio Rudiger of Germany don collect di first yellow card for dis match sake of one bad foul.

12’ Nico Williams of Spain tiff di ball from im opponent leg, but referee catch am con blow foul. Nico begin para.

11’ David Raum of Germany pass so ball into di box but Unai Simon interrupt di attack

10’ Nico Williams of Spain bin wan break free but Germany player clear di ball.

8’ Early substitutio for Spain sake of injury. Pedri don comot and Dani Olmo enta for am.

6’ Referee blow whistle again for foul afta Gundogan of Germany collect ball wit force.

4’ Toni Kroos of Genmany bring down im opponent and Referee blow whistle to stop di game.

2’ Rodri of Spain bin dey wait for di ball for di edge of di box, e play one powerful volley we go do bottom left corner but di goalkeeper of Germany save di ball.

1’ Match don start afta Referee Anthony Taylor blow whistle