Wia dis foto come from, Getty Images

10 September 2024, 09:54 WAT

Rwanda vs Nigeria - Figure 1
Photo BBC News

New Informate 19 minutes wey don pass

Wit ball possession of 50.9 percent, Nigeria fail to beat Rwanda wey get 49.9 percent for dia Afcon qualifier match.

FULL-TIME

Rwanda 0-0 Nigeria

Ball bakc in play. Referee blow FINAL WHISTLE.

90+5mins- Nwabali dey down and medical dey attend to am.

DIS RWANDA GOALKEEPER !!! Anoda save by Ntwari again from a long straight shot.

90+3mins- Super Eagles dey lose ball for di middle ooo, dem gatz move fast wit di ball and find dia players wey fit score for di front of goal. Moses Simon

Substitution' Ademola Lookman out, Awoniyi in.

Rwanda 0-0 Nigeria

90+1mins- Di Super Eagles trying to find dia way into Rwanda net while Rwanda too dey find space for di Nigeria net.

5 Mins Added Time

89mins- Why You Go Miss dat Kain Ball? Dat for be goal for Nigeria but di player miss am ooooo. Straight at di goalpost wit di keeper swinging to di oda side of di post, but e miss di chance to score.

87mins- A SAVE, Nwabali push dat shot wit all im power afta Rwanda play long low shot on target. Di Super Eagles defence gatz dey standby.

Another Save!!! Ola Aina try good shot but di Rwandan goalkeeper stop am ooooooo. Dis na confam shot on target for di Super Eagles.

84mins- Ball out for Rwanda as dem go try take dia throw-in. Dem put di ball back to play. Kwizera wit good play as e find Omborenga we fire straight but dem block am.

82mins- Onyeka is down afta dem step for im hand ooo. Nigeria wit good ba;; possession looking for goal wey fit enta di net from any angle. Dis match tight ooooo

80mins- A long shot by di Rwanda player right across di box 18 but Nwabali jump to catch di ball for air. Good pressure by Moses Simon for di Nigeria team.

79mins- Ademola Lookman find Moses Simon from di left angle, Simon wit one quick dribble pull out di ball for Osihmen to nod am enta net. Oh No, e no go through, ball still dey on.

77mins- Ball back in play fro di Rwandan team for dia own home but dem no see any goal for dis match as dia strikers dey dey push hard. Lookman wit di ball but no convert to goal oooo.

75mins- Corner kick taken by Rwanda.

73mins- ANOTHER SAVE!!! Onyemachi pull dat through but Rwanda goalkeeper catch am directly for im hand.

Ademola Lookman play di corner for Nigeria. But dem fall Omborenga down and di referee blow di whistle.

72mins- Brilliant Save by Rwanda goalkeeper Ntwari. Ademola Lookman hit di ball wit so much energy wey wan almost comot di keeper hand.

71mins- Ola Aina go need dey throw for di Nigeria team to score.

Substitution' Dele-Bashiru out, Onyedika in. Ndidi out too wit Onyeka entering for am.

Rwanda vs Nigeria - Figure 2
Photo BBC News

69mins- Di Rwanda team looking for chance again ooo, Kwizera Jojea wit good chance. Di ball go back to di hand of Kwizera, e fire di ball to goalkick oooo. E for put di ball for up to stress Nwabali but na low ball wey go out.

67mins- Ola Aina wit good dribble from di right wing looking for Osihmen but di ball o convert to goal. Di driblle from Aina fall di player down oooo.

65mins- Moses Simon playing wit Dele-Bashiru for di middle line, di ball go back go reach Nwabali wey pull long shot.

63mins- Rwanda and Nigeria dey face diasef comfortably, wit serious pressure by Osihmen for di Rwanda goalpost. Mugisha trying good chance for Rwanda but Nwabali catch di ball directly for hand.

Substitution' Gibert out as Mugisha enta for Rwanda.

61mins- Good calculation by di Super Eagles but Rwanda goalkeeper Ntwari Fiacre no gree.

59mins- Calvin Bassey wit good pass to Moses Simon, trying to find way into Rwanda net. Bassey cross di ball out wit Osihmen waiting to receive di ball but di defender clear ma comot.

Good run by di sub Osihmen but no card by di referee afta dem fall am down.

57mins- Di Rwanda tam get good defence now and di Nigeria team dey find am difficult to break into di net. Ndidi wit di good pass going forward.

55mins- Coach Eguavoen dy worry as di Super Eagles neva score any goal ooo, wetin go be im fate now. Bassey win a throw-in afta good square play from di midfield.

54mins- Long run by Simon Moses from a long shot played by Ndidi- Cleared by Rwanda goalkeeper into a corner.

52mins- Nice try by Dele-Bashiru but e go wide beside di goalpost. Dat na good attempt at di post, if e try am twixe, goal go show up for Nigeria.

Long ball but Nwabali catch di ball straight for im hand.

Rwanda 0-0 Nigeria

50mins- Anoda throw-in for Rwanda wit Fitina Omborenga throwing it as teammates bin possession dia sef.

48mins- Good possession by di Rwandan players from di rigjht side dis time around, Troost-Ekong clear di ball comot for Super Eagles box 18.

Di president of Rwanda Paul Kagame dey for di stadium to watch di game.

46mins- Victor Osihmen wit good chase and pressure for Rwanda defence

Substitution' Simon Moses in, Chukwueze out. Osihmen in, Boniface out.

SECOND HALF

HALF-TIME

Rwanda 0-0 Nigeria

Good game by dis two team as dem battle out for di Afcon qualifier but no goal yet.

45+4mins- A great save dia by Ekong. An di ball is back to play.

45+2mins- YELLOW CARD' Ola Aina chop anoda yellow for Nigeria as e pull shirt of a Rwanda player

45+1mins- Corner for Rwanda as dem quickly take am, but na easy catch for Nwabali. Strong run by Boniface towards di Rwanda team, but Boniface fall oooo and referee no give am free kick.

Rwanda vs Nigeria - Figure 3
Photo BBC News

4mins Added Time

45mins- Innocent of Rwanda wit a selfish ball dia, e for try play wit im teammate but e play am wide.

42mins- Nwabali having good control of di ball as e keep di ball for im side.

Rwanda 0-0 Nigeria

Anoda free miss by Onyemaechi.

40mins- Troost-Ekong wit good control. Chukwueze take di ball from di angle wit Ola Aina for di back.

38mins- Rwanda goalkeeper down. Ball bakc in play.

VICTOR BONIFACE!!! What a MISS afta im good placing hit di ball and Lookman no fit convert am too.

36mins- Rwanda dey play good ball from dis left side but Super Eagles defenders dey block am.

34mins- Good ball so far bu=y di two teams looking for goals from both net.

32mins- Ndidi wit good domination wit Dele-Bashiru at di middle. Dem dey control di ball well as dem also dey find Ademola Lookman fro di front.

30mins- Rwanda goalkeeper dey show say e sabi as dey fly evriwia to catch and push di ball comot for net.

29mins- Fourth corner kick for Nigeria. Lookman play am ova di head of di strikers, but Rwanda goalkeeper push am out.

Moses Simon and Iheanacho dey warm up- as Chukwueze still dey floor but e don stand.

Rwanda 0-0 Nigeria

YELLOW CARD' Rwanda captain Bizimana Djihad do foul for Chukwueze and di referee no waste time to waya am card.

27mins- Di Super Eagles dey make strong move, wit Dele-Bashiru wit good pass.

YELLOW CARD' Niyomugabo Claude of Rwanda and Chukuwweze of Nigeria chop yellow card for di same time.

25mins- What blocked shot from Boniface. Corner for Nigeria. Chukwueze don dey vex oooo

23mins- Corner taken by Ademola Lookman as ball go back in control.

GOAL CANCELLED. Ademola Lookman wit a strong hit inside di net but di referee cancel am.

21mins- Victor Boniface wit a long run wit di ball. Cleared by Rwanda defender. Ola Aina wi a throw-in.

19mins- A s e be now, Nigeria gatz do well wit dia forward as plenti ball dey miss for di frontline. No corner for di Super Eagles yet while Rwanda dey attack from di left angle to give Ola Aina more issue to deal wit.

17mins- Anoda corner kick for Rwanda to be taken by Muhire wey be dia star player. Danger for di Super Eagles inside di box 18, Nshuti Innocent try shot but e dey blocked. Ball back in play

Wia dis foto come from, Getty Images

Rwanda 0-0 Nigeria

Muhire to take free kick for di Rwanda team. Defender block di ball from entering di net.

14mins- ADEMOLA LOOKMAN!!!! what a SAVE by Rwanda goalkeeper. Lookman find correct position to place imsef as e drive forward but di keeper stop am.

13mins- Ola Aina wit a run from di left hand side, but no chance to shoot at di net.

Nwabali wit so much confidence on di goalpost as e block di ball

12mins- Wjhat a good block by Nigeria defender Bassey

Ademola Lookman playing from di upper right side, but nobody to support

11mins- Rwanda dey attack from di left side again wit Muhire putting pressure for di Super Eagles defence line.

9mins- Boniface trying to play from di middle as e find di team mate wey dey close to am. Calvin Bassey wit good run from di right side of di middle looking for Ola Aina, but e too hit di ball.

Goal kick for Nwabali, played wide into di middle

7mins- Rwanda moving form di left angle, good pass, as jersey number 11 Muhire Kevin try a long shot but too high, e go ova di bar.

Rwanda having some confidence and good control from di middle line wit good home support.

5mins- Corner kick for di Rwandan team, quickly taken wit beautiful shot by Djihad but di header go ova di goalpost.

4mins- Anoda straight move wit shot from Ndidi right into di box 18 of Rwanda, but di goalkeeper Fiarce catch am

2mins- Good blind run by Ademola Lookman from di angle of di pitch, but Onyemeachi no get chance score am

Goal kick for Nigeria as Nwabali dey in control of di ball

1min- Di Rwanda team start di match. Rwanda making progress towards Nigeria goalpost.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ademola Lookman and Victor Osimhen both score for Nigeria against Benin Republic on Saturday, September 7, 2024

Rwanda vs Nigeria line-up

Nigeria first eleven: Nwabali (G), 5. Ekong* [С), Aina, Ajayi, Onyemaechi, Bassey, Ndidi, Dele-Bashiru, Lookman, Chukwueze, Boniface

Substitutes: Okoye, Obasogie, Iheanacho, Osimhen, Onyeka, Simon, Awoniyi, Onyedika, Tanimu, Ndah, Alhassan, Iwobi

Rwanda first eleven: Ntwari Fiacre (GK), Omborenga Fitina, Niyomugabo Claude, Mutsinzi Ange, Manzi Thierry, Mugisha Bonheur, Kwizera Jojea, Bizimana Djihad (c), Nshuti Innocent, Muhire Kevin, Mugisha Gilbert

SUBS

Maxime, Adolphe, Yunussu, Ishimwe, Samuel Niyibizi, Nsabimana, Niyigena, Mugisha, Byiringiro, Gitego, Ruboneka