Portugal vs Slovenia: Live updates of Euro 2024 round of 16 game ...

3 days ago

Wia dis foto come from, Getty images

Wetin we call dis foto, Benando Silva of Portugal bin dey celebrate in first tournament goal for Portugal while Adam Gnezda Cerin don score five goals in 34 games for Slovenia

1 July 2024, 17:18 WAT

Portugal vs Slovenia - Figure 1
Photo BBC News

New Informate 30 minutes wey don pass

First Half

27’ Portugal get chance for counter attack as Bernardo Silva carry di ball dey run but e no work as dem plan am. Di all no reach Cristiano Ronaldo wey bin dey do box dey wait for di cross.

25’ Joao Palhinha of Portugal commit handball by 24’ Portugal dey try to drag Slovenia players out but e neva work.

22’ Zan Karnicnik of Slovenia bin wan pass one beta ball but Portugal players block am.

20’ Nuno Mendes of Portugal don get small injury as e call for medical help, but I’m don stand up and game don kontinu.

18’ Referee blow whistle for foul against Jan Malakai.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

16’ Bruno Fernandes cross ball into di box, but Slovenia defenders no dey sleep at all, dem clear di ball.

14’ Bernardo Silva of Portugal play one beta ball wey dey go di direction Bruno Fernandes for so box area but im no fit reach di pass. Di ball go out of play and na goal kick for Slovenia.

12’ Zan Karnicnik of Slovenia snatch di ball from im opponent leg but refere blow foul.

10’Vitinha play corner kick for Portugal but e land for dia opponent head.

9’ Portugal dey press Slovenia for opening minutes of dis match as Cristiano Ronaldo dey play fancy football wit im dribbling and jogging skills.

8‘ Cristiano Ronaldo try to dribble in opponent but referee ignore di call for foul.

7’ Vitinha of Portugal play one mid-range free kick but di cross no land well.

5’ Ruben Dias of Portugal goal attempt fly wide go di right post. Goal kick for Slovenia.

4’ Bruno Fernandes hit di ball go di penalty area but defender block am.

4’ Nuno Fernandes of Portugal run towards goal but defender clear di ball.

2’ Now now dem don raise flag for Bernardo Silva for offside

1’ Referee Daniele Oresto don blow whistle match don start.

Portugal and Slovenia go put leg inside one trouser on Monday as di Euro 2024 enta di crucial stages.

Portugal be like say dem stand a beta chance sake of say na dem bin win di tournament for 2016.

Meanwhile dis na di first time wey Slovenia dey reach di Round of 16.

Slovenia Midfielder Adam Gnezda Cerin say Slovenia no dey satisfied say dem reach di last 16 for di Euro 2024.

Slovenia bin play goalless draw against England for dia final Group C match wey help Slovenia qualify as one of di four best third-placed teams.

"Dis na new milestone for di Slovenian national team, for Slovenia in general," Gnezda Cerin tok.

"We get our goals and I tink say on Monday match go be a beautiful evening for everyone to enjoy sake of say these matches na somtin you dream about as small pikin wey just start to play football.

"We neva finish. We go try to play Monday match at di highest possible level."

Slovenia, just dey appear for only dia second European Championship, dem drew dia three group matches.

"We don prepare for Portugal," Gnezda Cerin, wey dey play for Panathinaikos tok.

"Dem be a very, very talented team and dem fit cause problems for us all around di pitch."

Portugal win Group F even though dem lose 2-0 to Georgia for dia final group game.

Dem don at least reach di quarter-finals for five of dia past six European Championships, including winning di tournament for 2016.

Slovenia win 2-0 wen dem bin jam Portugal for friendly game for March, dem end Portugal run of 11 victories in a row.

Meanwhile, midfielder Bruno Fernandes say di defeat wey Georgia give Portugal don put dem "on dia toes" for di game wey go happun for Frankfurt.

"We no get plenti time to tink about wetin bin happun. We get to tink about wetin go happun," na wetin Manchester United Fernandes tok.

"We respect evri opponent. Dis [Slovenia] team get beta important names, high-quality players - we respect dem well well.

"Afta di bad results, pipo get to focus on di negative aspects, but na like dis football dey work."

Line ups

Portugal starting 11: Diogo Costa, Nuno Mendes, Pepe, Rúben Dias, João Cancelo,

João Palhinha, Vitinha, Rafael Leão, Bruno Fernandes, Bernardo Silva, Cristiano Ronaldo

Slovenia starting 11: J. Oblak, Balkove, J. Bijol, V. Drkušić, Ž. Karničnik, J. Mlakar

T. Elšnik, A. Gnezda Čerin, P. Stojanović, B. Šeškol, A. Šporar

Best of Stats

Portugal bin qualify from di group stage for all dia nine Euro campaigns.

Slovenia and Denmark become di second and third nations to draw all three of dia group stage matches for European Championship. Di first team wey do am na Portugal on dia way to winning di Euro 2016.

Cristiano Ronaldo neva score goal for seven major tournament appearances for Portugal, even though im bin attempt 19 shots for dis run – na di longest time wey im never score.

Slovenia dey average 32% possession for Euro 2024.

Vitinha don complete more line-breaking passes (29) dan any oda Portugal player for Euro 2024.

Read more
Similar news
This week's most popular news