Wia dis foto come from, Getty Images

18 December 2023

Defending champions Manchester City go play Copenhagen for di last 16 of di Champions League, while Arsenal go face Porto.

Porto FC - Figure 1
Photo BBC News

Danish champions Copenhagen, wey bin finish above Manchester United for dia group, reach di knockout stage for di first time since 2011.

Di first legs go take place on 13-14 or 20-21 February and the second on 5-6 or 12-13 March.

City and Arsenal bin dey seeded, e mean say dem go play di second leg at home.

14-time winners Real Madrid go meet RB Leipzig, while Inter Milan - runners-up last season – go play Atletico Madrid, and Bayern Munich go face Lazio.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Di final go take place for Wembley on 1 June.

Champions League Round of 16

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Champions League Round of 16 fixtures

Porto FC - Figure 2
Photo BBC News

FC Porto v Arsenal

Napoli v Barcelona

Paris St-Germain v Real Sociedad

Inter Milan v Atletico Madrid

PSV Eindhoven v Borussia Dortmund

S.S Lazio v Bayern Munich

FC Copenhagen v Manchester City

RB Leipzig v Real Madrid

Premier League leaders Arsenal, wey bin top Group B but dem never win Champion League before, bin beat Porto 5-0 for Emirates Stadium di last time dey meet for 2010.

Runners-up for Portugal Primeira Liga last season, Porto don win four of dia six Group H games to finish level on points wit Group H winners Barcelona.

City win Group G with a 100% record, while Copenhagen, wey bin lose 1-0 for United before dem beat dem 4-3 at home, na runners-up to Bayern in Group A.

Pep Guardiola side don progress from di last 16 stage for each of di past six seasons for Champions League.

Analysis

Ian Dennis, BBC Radio 5 Live senior football reporter

Di draw dey very kind to di two English teams, di two of dem suppose dey very happy.

Arsenal don win all three previous encounters against Porto, although dem neva win for di Estadio do Dragao.

City bin play Danish champions Copenhagen for di group stage last season, dem bin play 0-0 draw for Denmark but win dem well-well 5-0 for home home.