Nigeria vs Benin Republic highlights: Finidi George team Super ...
Nigeria lose to Benin for 2026 World Cup qualifier
Wia dis foto come from, Super Eagles
10 June 2024
Benin come from behind to beat Nigeria 2-1 for dia group C World Cup qualifying match.
Mounni score di winner for Benin afta Dossou bin equalise Nigeria goal wey Onyedike score.
Di result mean say Nigeria dey fifth position wit four points for table, while Benin dey top group C wit seven points.
If di oda teams for di group win dia games Nigeria go dey bottom of di group.
Di Africa edition of di 2026 World Cup qualifiers go kontinu for almost two years.
Skip Recommended articles and continue reading
Recommended articles
End of Recommended articles
See di match highlights
Second Half
46 Mins- Match don start
47 Mins - Benin push for a third goal but di striker foul Nigerian player
48 Mins - Bad pass from Nigeria, free kick to Benin
49 Mins- Long range shot from Benin di ball go ova di bar
50 Mins- Iwobi and Moffi don comot Boniface and Onuachu don enta
53 Mins- Goal kick to Benin
54 Mins- Big chance for Nigeria! Chukuweze cross inside di box but Lookman header weak
55 Mins- Free kick to Nigeria inside dia half
56 Mins- Throw in to Nigeria, SSupr Eagled try to attack from di right side but Benin defence clear di danger
58 Mins- Free kick to Benin afta Lookman foul di defender
59 Mins- Double Substitution for Nigeria
60 Mins- Throw in to Benin and na long on but Nwabali catch am
61 Mins- Referee don blow in whistle for foul against Nigeria inside Benin Penalty box
64 Mins- Long cross on di right from Nigeria but Benin defence clear di ball
65 Mins- Nigeria try dis time from di left wit Boniface no way
66 Mins-- Corner Kick for Nigeria, big clearance from Benin defence
67 Mins- Goal kick to Benin
68 Mins- Nigeria try again from di back but anoda bad pass to allow Benin striker clean on goal but Nwabali clear am
70 Mins- Nigeria give di ball away again but Benin striker no get chance to shot
72 Mins- Free kick to Benin, long ball straight to Nwabali
74 Mins- Benin dey play wit confidence
75 Mins- long throw from Ndidi but di shot dey deflected for corner kick
76 Mins - Corner kick to Nigeria but Benin defence clear Lookman cross
78 Mins- Substitution for Nigeria, Ndidi don comot for Yusuf
79 Mins- Free kick to Nigeria
81 Mins- Free kick to Benin, di team dey very organised
82 Mins- Nigeria try through di middle wit long ball but e no work
83 Mins- Cross from di right side for Nigeria but na Benin player head meet am
84 Mins- Corner kick for Nigeria, dem cross d ball inside di box but di header go ova di bar
86 Mins- Substitution for Benin Olaitan don comot for Ahlinvi
87 Mins- Poor cross from di right from Nigeria wey go straight to di goalkeeper
90 Mins+5- Nigeria try to attack from di left but di pass too long for Lookman throw in to Benin
91 Mins- Nigeria try again from di right wing but Benin defend well
92 Mins- Chance for Nigeria as dem struggle for di ball inside di penalty ball, referee blow for foul
95 Mins- FT Benin 2-1 Nigeria
First Half
1 Min- Match don start
2 Mins- Lookman attempt at goal go wide for goal kick
3 mins- Nwabali pass to Bassey as Nigeria try to build from di back for Benin players clear di ball
9 mins- Throw in to Nigeria, Chukwueze try to dribble inside di penalty area but di defence clear di ball
11 Mins- Danger for Nigeria defence as Nwabali clear di ball out
12 Mins _ Chance for Nigeria but Osayi shot just miss di goal small
13 Mins- Free Kick to Nigeria afta Benin player foul Lookman.
14 Mins- Corner Kick to Nigeria but defence clear di ball
15 Mins- Throw to Nigeria, di Super Eagles dey put Benin under pressure
16 Mins- Free kick to Benin afta Ajayi fowl
17 Mins- Poor bass from Bassey na throw in to Benin
18 Min- Benin try to attack Nigeria but di defence do dia job
20 Mins- Ndidi long pass to Lookman but di Benin defence clear di danger
22 Mins - Benin captain dey ground referee don blow whistle for free kick
23 Mins- Free kick to Benin, danger for Nigeria but Osayi clear di ball for corner kick
25 Mins- OFF side for Benin from dia corner kick but Nwabali no take chances e save di ball
25 Mins- GOAL ! Onyedika score for Nigeria na Chukwueze give am di pass
32 Mins- Danger for Nigeria as Olaitan beat two defenders bifor Ajayi clear di ball for corner kick
33 Mins- Nigeria lose di ball for dangerous area Benin get throw in
34 Mins- Foul against Benin na free kick to Nigeria
35 Mins- Long pass to Chukwueze but im no fit beat di Benin defender
36 Mins - Goal! Benin don equalise Dossou na im score afta Bassey miss di ball
41 Mins- Ndidi pass find Lookman but dem no fit break Benin defence
43 Mins- Substitution Dossou don comot Tosin don enta
46 Mins- Corner Kick for Benin
47 Mins - Goal! Mounie score for Benin
Halftime- Benin 2-1 Nigeria
Benin vs Nigeria line up
Benin starting XI: Dandjinou, D' Almeida, Dodo, Dossou, Hountondji, Imourane, Kiki, Moumini, Mounie, Olaitan, Tijani
Subs: Ahlinvi,Ahouangbo, Allagbe, Amoussou, Dossou, Fassinou, Karim, Roche, Sankamao, Tchetchao, Tosin
Nigeria starting XI: Nwabali, Ajayi, Bassey, Tanimu, Osayi- Samuel, Onyedika, Iwobi, Ndidi, Chukwueze, Lookman, Moffi
Subs:Iheanacho, Boniface, Onuachu, Abdulahi, Dele- Bashiru, Onyeka, Awaziem, Olawoyin, Igboke, Ismaila, Oloye, Ojo
Head-to-Head
Nigeria dey always dominate against Benin Republic afta dem win 13 of dia 16 games, wit two draws and one loss.
Di Super Eagles win dia last three matches against Benin while di only victory by Benin na for 2017.