7 September 2024, 11:32 WAT

New Informate one hour wey don pass

Nigeria vs Benin - Figure 1
Photo BBC News

Nigeria begin dia road to qualification to di 2025 Africa Cup of Nations wit comfortable 3-0 victory ova Benin for di Godswill Akpabio International Stadium for Uyo.

Di Super Eagles shake off dia World Cup qualification woes and bring joy to dia supporters thanks to two goals from Ballon d'or nominee, Ademola Lookman and a volley from substitute Victor Osimhen see dem defeat di Squirrels of Benin on Saturday.

Ademola Lookman solo run and strike just before halftime calm fans of di Super Eagles wey bin don begin to dey show dia frustration inside di 'Nest of Champions'.

Wit just minutes afta e come on as substitute, new Galatasaray signing Victor Osimhen show why im be striker to reckon wit for di continent. Di Napoli-loanee volley in Ndidi cross beyond di goalkeeper to increase Nigeria lead on 79 minutes.

Five minutes afta Osimhen strike, Lookman seal di victory wit a header from Moses Simon cross.

Much of di celebrations wey fill di Godswill Akpabio stadium air dey in sharp contrast to how Nigerians bin feel wen dis same Benin side defeat di Super Eagles in June during a World Cup qualification match.

Dat defeat and poor start to World Cup qualification lead to den Nigeria coach Finidi George announcing im resignation as coach of di Super Eagles amongst oda reasons wey im give.

Dis latest victory also see di Super Eagles condemn dia former coach, Gernot Rohr side to a first defeat for dia first Afcon qualification match for di group wey also include Libya and Rwanda.

Nigeria win go also sweet di belle of coach Austin Eguavoen wey only dey in charge of di Super Eagles on interim basis afta di Nigeria Football Federation stall for dia negotiation wit German coach Bruno Labbadia.

Nigeria vs Benin - Figure 2
Photo BBC News

As e stand, Nigeria dey top of di group wit three points. Rwanda and Libya get one point each, all four teams don play one match each for di group.

Nigeria next dey in action on Tuesday 10 September wia dem go take on Rwanda while Benin go Play Libya on di same day.

Read more

Second half

Wetin we call dis foto, Osimhen score six minutes afta e come on

Full Time: Nigeria 3-0 Benin

90 mins - Di ninety minutes don complete and Benin no look like finding dia way back into dis match.

84 mins - Goal for Nigeria! Ademola Lookman rise high to head in Moses Simon cross into di net.

Nigeria 3-0 Benin

81 mins - Osimhen almost score e second, e try to dribble past di goalkeeper, but Dandjinou dive low to stop di striker from scoring.

80 mins - Nigeria make dia final substitution: Raphael Nwadike enta di match in place of Ndidi wey don taya.

79 mins - Victor Osimhen! Di new Galatasaray signing volley Ndidi cross beyond di Benin goalkeeper and into di net.

Nigeria 2-0 Benin

74 mins - Benin threaten Nigeria goal through Dossou shot from just outside di box, Troost-Ekong head di shot clear.

72 mins - Victor Osimhen don enta di match as substitute in place of Boniface.

67 mins Benin send on Dossou for D'Almeida for dia first substitution of di match.

65 mins - Steve Mounie almost equalise for Benin as im test Nwabali twice in di space of seconds. Both times Nwabali prove to dey equal to di task as e save di striker shots well.

63 mins - Substitution for Nigeria: Bassey, Iwobi and Chukwueze all come off. Moses Simon, Dele Bashiru and Olisah Ndah don replace dem

Nigeria vs Benin - Figure 3
Photo BBC News

61 mins - Yellow card for Olaitan for bringing down di lively Lookman.

59 mins - Nigeria look like dem dey prepare to make change for dis second-half.

52 mins - Meanwhile di Nigeria forward also dey in di thick of things, im race through on goal afta collecting one fine pass from Iwobi. Lookman dribble di keeper but fail to go past di onrushing Houtoundji wey stand gidigba block di ball.

51 mins - Yellow card for goalscorer Lookman due to late tackle im make on Tosin.

48 mins - Nigeria win early cornerkick through deflected shot by Kiki. Di cornerkick no result to anytin as lack of communication see Lookman cross go beyond all di men in green shirts.

46 mins - Di second half don resume wit Nigeria in di lead thanks to Ademola Lookman late strike just before di break.

First half

HT: Nigeria 1-0 Benin

Dat late goal just before half-time bring di first half to a close. Nigeria don dominate di match so far but dem dey lead Benin by just one goal.

45+2mins - Goal for Nigeria! Ademola Lookman dribble im way into di Benin box den e cooly slot e shot into di keeper bottom right corner.

Nigeria 1-0 Benin

45 mins - Di match still dey goalless so far, di referee don signal to add two more minutes before di break.

41 mins - Nwabali use e strong hands to palm Tosin freekick away. Dat na Benin first shot on target for dis match.

39 mins - Yellow card for Calvin Bassey afta e handle di ball just outside Nigeria eighteen-yard box.

31 - Lookman thread di ball to Onyemaechi, di full back cut ball in for Boniface before e go reach di ball di goalkeeper palm am clear at e feet.

27 mins - Benin player bring down Chukwueze from just outside di box. Di AC Milan man pick imsef up before e test di goalkeeper wit di freekick wey Dondjinou save well.

25 mins - Victor Boniface fail to connect wit Chukwueze deflected cross from just inside di area.

21 mins - Di Super Eagles of Nigeria don dey in possession of di ball di most so far wit 76% ball possession. But dem neva fit make dia control of di match count.

15 mins - Nigeria go close to open di scoring as Lookman again try to squeeze im shot from a tight angle past di goalkeeper. Di ball go narrowly wide of di post.

12 mins - Lookman cross from cornerkick find Boniface, di striker attempt to jab di ball dey tame.

10 mins - Chukwueze try to find Lookman wit one ova di top pass, di Atalanta forward reach di ball come try to chip di goalkeeper. E attempt go wide, e for no count sef as di linesman raise e flag for offside.

1 min - Benin don begin di match and straight dem go on attack wey Nwabali quickly snuff out.

Nigeria 0-0 Benin

Nigeria vs Benin lineup

Nigeria XI: Nwabali; Aina, Ekong, Ajayi, Bassey, Onyemaechi; Ndidi, Iwobi; Lookman, Chukwueze, Boniface.

Benin XI: Dandjinou; Moumini, Houtondji, Tijani, Kiki; Imourane, D'Almeida, Dokou; Olaitan, Dossou, Mounie.