Netherlands vs Turkey live: Uefa Euro 2024 quarter final game

6 Jul 2024

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Netherland beat Romania 3-0 for dia last match

6 July 2024, 18:14 WAT

Netherlands vs Turkey - Figure 1
Photo BBC News

New Informate 2 minutes wey don pass

9 mins - Ozcan try better shot from outside di box, di shot no trouble di keeper at all.

1 min - Di last quarter-final fixture - Netherlands vs Turkey - of Euro 2024 don start!

Date, kick-off time and venue

Kick -off time for Netherlands against Turkey 8pm WAT on Saturday July 6, 2024.

Netherlands vs Turkey - Figure 2
Photo BBC News

Di match go take place for di Olympiastadion for Berlin.

How to follow Netherlands vs Turkey match

Di match dey live on SuperSport for pipo wey dey Nigeria.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Netherlands vs Turkey - Figure 3
Photo BBC News

You fit also follow di live text coverage on BBC Pidgin website.

Team news

Turkey go dey without Merih Demiral sake of im two-match ban for im ultra-nationalist salute during dia last-16 win against Austria.

Midfielders Orkun Kokcu and Ismail Yuksek also dey suspended, but Hakan Calhanoglu and Samet Akaydin dey available afta dia ban.

Netherlands vs Turkey - Figure 4
Photo BBC News

Di Netherlands no get injuries or suspensions, although Donyell Malen fit start for dem afta im score twice as a half-time substitute for dia 3-0 win against Romania for di last 16.

Match stats

Di past two matches between di Netherlands and Turkey don see a total of 13 goals. Turkey bin win 4-2 for March 2021 and di Netherlands bin win 6-1 for September 2021, both na for qualifiers for di 2022 World Cup.Di Netherlands don progress from five of dis past seven major tournament quarter-finals (World Cup/Euros), although one of di two exceptions na di most recent, dem bin lose penalty shootout to Argentina for di 2022 World Cup.Dis na di fourth time wey Turkey don reach di quarter-final stage for major tournament, afta Euro 2000, di 2002 World Cup, and Euro 2008. Dem bin reach di semi-final of di last two, dem only fail for Euro 2000 when dem lose 2-0 to Portugal.Turkey don collect 18 yellow cards for Euro 2024; for European Championship history, only di Czech Republic for 1996 get more cards for single edition (20 - 19 yellows, one red). Dem don pick up at least two cards in each of dia past 24 matches for major tournaments.Across di 2022 World Cup and Euro 2024, di only European player wey get more goals pass di Netherlands Cody Gakpo (6) na Kylian Mbappe (9). All six of Gakpo strikes come for different matches.

Another thing we de for inside dis tori

Netherlands vs Turkey - Figure 5
Photo BBC News

Top Tori

Informate me

De one we dem de read well well

Netherlands vs Turkey - Figure 6
Photo BBC News
Netherlands vs Turkey - Figure 7
Photo BBC News
Read more
This week's most popular news