Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Secret Service Director Kimberly Cheatle so far dey resist mounting calls to step down

one hour wey don pass

Kimberly Cheatle - Figure 1
Photo BBC News

Democratic and Republican lawmakers for America don call on Secret Service Director Kimberly Cheatle to step down, afta di assassination attempt of Donald Trump.

Dem make di call during and afta one hot House Oversight Committee hearing on Monday, wia dem question Ms Cheatle about her agency security preparations before di 13 July rally for Butler, Pennsylvania, wey lead to di attempt on Trump life.

One pesin die and three odas including di former president injure sake of di shooting.

'Vacate your office' - Lawmakers demand

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, James Comer (left) say Ms Cheatle no need to provide di required answers

Monday hearing bin dey bad for Ms Cheatle, as lawmakers mock her answers and di lack of information di agency bin make public.

For nearly six hours, di lawmakers bin try to find answer to questions about di shooting, wey include how di suspect Thomas Matthew Crooks, fit climb nearby rooftop and why dem allow Trump climb di stage even afta report of suspicious pesin.

Afta di hearing, di leading Republican and Democrat from di committee - James Comer and Jamie Raskin – bin send one letter to Ms Cheatle wey lay out dia belief say make she vacate her office.

"For di middle of a presidential election, di Committee and di American pipo dey demand serious institutional accountability and transparency wey you no dey provide," di letter tok.

"We call on you to resign as director as first step to allow new leadership to quickly address dis crisis and rebuild di trust of a truly concerned Congress plus di American pipo."

While Ms Cheatle take responsibility during di hearing for di security lapses and agree say di Butler incident mark "di most significant operational failure of di Secret Service in decades", she bin leave many lawmakers frustrated.

Ms Cheatle don ignore di calls for her to resign, she say she be di "best pesin to lead di Secret Service at dis time".

Di Secret Service director also answer few questions directly – she say di investigation dey on.

"American pipo get questions, [and] dem deserve answers," Oversight Committee Chairman Mr Comer tell Ms Cheatle.

Kimberly Cheatle - Figure 2
Photo BBC News

"You suppose provide answers and, ma'am, you no do am."

At times, di hot hearing go be like say e don turn to battle field as di lawmakers seriously dey para as dem dey tok.

Lawmakers use curse words, shout for di witness and question di director honesty and competence.

"Your performance tire me," Florida congresswoman Anna Paulina Luna tok.

E be like say Ms Cheatle answers dey always vex di lawmakers wey dey di committee, many of dem tok say make dem free her if she continue to refuse to resign.

Throughout di hearing, some representatives roll dia eyes, or mumble loudly in response to Ms Cheatle comments.

For one of di hottest moments of di hearing, South Carolina Republican Nancy Mace tok say Ms Cheatle no dey honest wit her answers.

"You dey dishonest or dey lie," Ms Mace tok. "You just dey dodge di questions!" She later file congressional motion to impeach Ms Cheatle, to force her out of di job.

Anoda Republican, Georgia Marjorie Taylor Greene, bin shout for Ms Cheatle head, and refer to her as "total failure".

Oda members, like Colorado Lauren Boebert and Ms Luna of Florida, bin hint say conspiracy theories don surface online.

Florida Republican Michael Waltz blame Ms Cheatle for di rumours, as e argue say misinformation "dey fly" for di absence of information.

"I for don fire you just by how you handle dis mata," Oga Waltz tok, "because na you suppose first face di mics."

Several eyewitnesses to di shooting for Butler bin tell BBC say Ms Cheatle answers bin leave dem feeling frustrated and angry.

"She dey try to pass di responsibility," Jean Vincent, one Butler resident tok. "I surprise at how her answers no reach. She need to dey held accountable for her total lack of competency... she put our lives at risk and need to take responsibility."

Kimberly Cheatle profile

Kimberly Cheatle na di 27th Director of di U.S. Secret Service.

Dem swear am in to office 17 September 2022.

She dey responsible for successfully executing di agency integrated mission of protection and investigations by leading a diverse workforce wey get more dan 7,800 Special Agents, Uniformed Division Officers, Technical Law Enforcement Officers, and Administrative, Professional, and Technical personnel.

Before her appointment, Ms. Cheatle serve as Senior Director for Global Security for PepsiCo, where she bin dey responsible for directing and implementing security protocols for di company facilities for North America.

Her role for PepsiCo na to develop risk management assessment and risk mitigation strategies.

Before she join PepsiCo, she bin work wit distinction for 27 years for di U.S. Secret Service, most recently as Assistant Director of di Office of Protective Operations.

For dis position, Ms. Cheatle manage one $133.5M budget and collabo wit ten operational divisions plus di Technical Security Division to research, develop and deploy technologies wey reduce risks to protectees, protected facilities, and protected events.

Before her service as Assistant Director, Ms. Cheatle bin work as Special Agent in Charge of di Atlanta Field Office, she bin provide oversight for all mission related investigations, protective intelligence and protective visits for di state of Georgia.

Dem later appoint Ms. Cheatle go di Senior Executive Service (SES) for February 2016 as di Special Agent in Charge of di James J. Rowley Training Center (RTC). For dia, she direct and coordinate all aspects of training and career development for di organization, later she serve as di Deputy Assistant Director for di Office of Training.

Prior to her SES appointment, Ms. Cheatle na di Special Agent in Charge, Office of Strategic Planning and Policy, wia she develop and deploy one innovative web-based communication platform wey dey designed to promote open and transparent communication within di organization.