Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di couple don marry since 2018Author, Malu CursinoRole, BBC News

7 hours wey don pass

Justin Bieber - Figure 1
Photo BBC News

Canadian singer Justin Bieber don announced di birth of im first child wit im wife Hailey Bieber.

For one Instagram post, Bieber bin share picture of im newborn son small foot.

"Welcome home," Bieber bin write for di caption for di early hours of Saturday morning, reveal im name as Jack Blues Bieber.

Katy Perry and Kylie Jenner bin dey among di famous faces wey congratulate di couple.

"Your blessing don arrive," Perry bin write as comment to Bieber post.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Meanwhile, Jenner bin write: "I no fit handle dis little foot".

Announcing dia pregnancy for May, di couple bin share one video and images of Hailey wia she debut her bump for one white lace dress.

Justin Bieber - Figure 2
Photo BBC News

Di 27-year-old American model and di pop singer bin get married for one secret ceremony for New York for 2018.

Wia dis foto come from, Justin Bieber

Wit popular hit-songs Baby, Love Me and Yummy, Justin bin rise to fame as one singer wen e be just 13 years old.

Last year, Justin dey forced to cancel di remaining dates of im Justice world tour for middle of one ongoing recovery from Ramsay Hunt syndrome, one condition wey fit cause facial paralysis.

Di Canadian singer bin unexpectedly step on stage for Coachella last month to perform 2020 hit single Essence, alongside Wizkid, during one set by Nigerian star Tems.

Hailey, di daughter of actor Stephen Baldwin and niece of actors Alec, William and Daniel Baldwin, na di founder of one skincare line, Rhode.

Justin Bieber - Figure 3
Photo BBC News

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Afta news of her pregnancy, Hailey bin dey pictured for New York for June wit her baby bump

Justin Bieber bin share one video for im Instagram page on 9 May wey show im wife Hailey Bieber dey hold her baby bump.

But Justin Bieber no tok anything more to explain di video.

Famous faces including US reality star Kim Kardashian and model Gigi Hadid post dia congratulations under di announcement for Instagram.

Although im no tok anything, pipo don flood dia social media pages to congratulate di couple.

Skip Instagram post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post