Joe Biden news conference: Video of moment US president call ...
12 July 2024, 11:01 WAT
New Informate 3 hours wey don pass
US President Joe Biden mistakenly refer to Vice-President Kamala Harris as 'Trump' during one Nato press conference.
Di mistake bin come hours afta e refer to Ukrainian President Volodymyr Zelensky as “President Putin” while e dey speak to reporters about Nato support for Ukraine.
E correct di mistake about Ukraine leader quickly but im no correct di second one even as some reporters for di room dey surprise and several of im top Cabinet secretaries sit down strong face for wia dem siddon.
For di press conference, im also make case for why im go stay on for di presidential race and why e believe say im na di best candidate to defeat Donald Trump.
Skip Recommended articles and continue reading
Recommended articles
End of Recommended articles
Joe Biden take to di stage for the press conference on Thursday night wia e tok about everytin around presidency, re-election hope, political life and im opponent.
For di hour-long session to mark di end of Nato summit, Biden tok plenti tins—even afta im earlier introduce Ukraine President Zelensky as "President Putin" for one separate event.
Di news conference na im first appearance wey no get script afta di debate wit rival Donald Trump, wey no too end well for am.
Na part of wetin lead to calls from several Democratic politicians and donors wey say make im drop out of di race for president.
E shake off concerns about im campaign wey reporters for di press conference ask am again and again.
For di news conference, e throway di rofor-rofor about im campaign wey reporters bin ask plenti times.
E promise say im dey fight to finish di job wey e start wen e take office for 2021.
“If I slow down and no fit get di job done, dat na sign say I no suppose dey do am, but dat neva dey yet.”
Minutes afta di news conference finish, several Democratic members of Congress publicly call say make Mr Biden step down.