Ghana 1- 2 Central Africa Republic 2026 World Cup qualifier live

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Ghana vs Central African Republic - Figure 1
Photo BBC News
Wetin we call dis foto, Ghana beat CAR 2-1 in September for di Baba Yara stadium

10 June 2024, 10:42 WAT

New Informate 2 minutes wey don pass

Second Half

45" Thomas Partey don dey ginger im boys for di second half.

45" Di players don emerge for di second half of di game. Ghana coach Otto go hope say im halftime team tok go reflect for pitch.

But for CAR coach Savoy, im team gatz to keep di pressure and possibly get some more goals.

First Half

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Halftime

Referee don blow whistle for halftime Ghana 1 - 2 CAR

45" Dem add 2 minutes for di first half

45" CAR tink say dem score dia third goal, wit anoda thru ball wey cut di defense but di linesman don raise flag

43" Namnganda from CAR drive into di ghana box agaion afta anoda lose ball from di blackstars, but im final shot na terrible.

42" Dat goal don shock di blacstars as all di defenders fail to clear di ball. Thomas Partey di captain don vex.

39" GOAL! CAR score through dia star striker Mafouta. Di striker collect one ball wey im beattwo defenders and scramble di ball under di goalkeeper.

1-2

38" Samed Salis don strike anoda shot into row Z! Kamaldeen try for di flanks wey im cutback to di midfielder, but im shot fly ova.

36" Ghana dey try anoda attack, from Sulemana to Kudus but di Westham man im pass into Jordan don reach di opponent. CAR begin to counter but Kondogbia im cross neva find im teammate.

33" Di last few minutes of di game don calm down

Ghana wit 5 goal attamepts and CAR wit 3 attempts so far.

31" CHANCE! Kamaldeen sulemana don drive into di CAR area wit pace but im shot go wide.

28" CAR win throw ball inside di blackstars area, but dem lose di ball to Ghana wey Ghana win throw. Di CAR captain Kondogbia don dey ground dey scream say im hurt. Referee don pause di game for medical attention.

Ghana vs Central African Republic - Figure 2
Photo BBC News

25" Blackstars dey try sustain some pressure inside di CAR area, but afta two throw ins, di ball don end up for a CAR defender wia im clear am.

23" Namganda and mafouta dey cause wahala for di blackstars defense.

22" CAR dey create chances for diaserf. Dem beat di Ghana backline again but di striker blast wide afta im dance inside di box.

21" Kudus fly di freekick into di area, but Salisu im header go wide. Di Monaco defender dey shout for penalty say dem pull im shirt.

20" Seconds afta im blast wide, Jordan win freekick for di left side of di CAR are, few yards from di penalty box.

18" OVER! Jordan Ayew don blast one shot way off target from distance afta Fataw and Gideon Mensah combine for di right wing.

16" CHANCE for CAR. Poor backpass from Djiku nearly make di wild beasts get goal opportunit, but Ati-Zigi clear am for corner. Di blackstars don clear di eventual ball

15" Ghana win throw afta Kudus try to evade im marker around di middle of di park.

14" OFFSIDE! Linesman don raise flag for Jordan as im try to beat di CAR backline

11" GOAL! CAR equalize. Mafouta beat di defensive line afta one ball ova di top. Im take a touch wit im face and strike di ball into di net.

1-1

9" Di balckstars launch anoda attack wit Fataw Issahaku. Im pass di ball to Kudus but im weak shot afta jordan don cut di ball back dey weak.

8" Di last two minutes don dey scrappy as both teams try to create sometin.

7" CAR try to create sometin afta going down by dat goal, but Mafouta stumble inside di box wey di chance don vanish.

5" GOAL! Jordan Ayew send di keeper di wrong way and Ghanaq lead 1-0

3" PENALTY! Ghana don win penalty as di defender hack Fataw Issahaku down. Jordan go take am

2" Both teams dey try to settle for di early exchanges.

Ghana vs Central African Republic - Figure 3
Photo BBC News

1" From di start Ghana don begin to attack wit Jordan on di far right of di CAR area wia im win freekick. Thomas partey don dey stand by dis free-kick but Mo Kudus take am.

1"

Game don start

Ghana coach make three changes for dis game.

Crystal Palace forward Jordan Ayew, Leicester City winger Issahaku Fatawu and Southampton left winger Kamaldeen Suleman all don start for Ghana.

Starting XI for Ghana:

Ati-Zigi (GK); Alidu, Djiku, Salisu, Mensah, Partey, Salis, Issahaku, Kudus, Kamaldeen, Jordan

Starting XI for CAR:

Dominique Youfeigane (GK); Yangao, Youga, Ndobe, Tatolna, Kondogbia ©, Piroua, Solet, Namnganda, Mafouta, Baboula

Di Baba Yara sports stadium na fortress for di blackstars as dem neva lose any world cup qualifier for dia.

In fact, for all competitions, Ghana don play 23 games for dat stadium wia dem win 17 wit 6 draws.

Di only defeat in all competitions for dat stadium happun in di year 2000.

Black stars coach Otto Addo dey hope di fans for Kumasi go cheer dem to anoda victory.

But di game no go dey easy as Central African Republic don dey 4-game unbeaten streak, wey dem concede only one goal.

Background

Di Blackstars of Ghana off di back of dia late 1-2 win for Mali last week dey hope say dem go a step closer to qualifying for di World Cup wit home game vs Central Africa Republic on Monday.

A late Jordan Ayew goal for extra time in Bamako seal all three points for di black starts in coach Otto Addo im first competitive game afta im re-appointment as coach.

Ghana dey sit for third place on di table wit 6 points, di same points as group leaders Madagascar and Comoros for second place.

Na goal difference dey separate di top three teams.

Mali dey fourth wia Ghana im Monday night opponent, CAR dey fifth wit 4 points and Chad dey bottom wit zero points.

Ghana vs Central African Republic - Figure 4
Photo BBC News

Coach Otto Addo know say e go be difficult game afta dia last-minute win for Mali wia neva lose home game for two years.

Im tok for pre-match press conference say “we no fit relax afta dat game. We for kontinue to push, wia di support of di home fans go be critical.”

Di last time di blackstars play for di baba yara sports stadium na afta di poor Afcon campaign for Cote D’ivoire, but di fans still fill di stadium to support di team.

Coach Otto Addo neva dey take dat support for granted.

“Di support of di Kumasi fans be unbelievable and dem don dey support even wen di team dey di lowest.”

Di last time Otto dey involved for game inside di baba yara sports stadium na 2022 World Cup qualifier wit super eagles of Nigeria wey end nil nil.

“Dia support against CAR go make di difference,” coach Otto add.

CAR gatz good offensive transition, wia we for stop dem on Monday.

For Blackstars poster boy Mohammed Kudus, “our focus be say we go dey di 2026 World Cup. Every player wan go di World Cup, e no dey mata how we go get dia.”

Im add say im den im colleagues gatz to give dia best to achieve dia goal.

“We dey readi to maintain our winning run - we want win all our remaining matches.”

“We go defeat CAR on Monday,” Kudus assure di fans.

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di blackstars still dey without captain Andre Ayew, Inaki Williams and Joseph Paintsil for dis match

CAR coach dey confident as e dey go Kumasi

For coach of CAR Raoul Savoy, di team don train well afta dia 1-0 win vs Chad.

“We dey come play good game vs di black stars for Kumasi just like we play last September wen we come here,” im tok.

For dat match in Kumasi, coach Savoy don grab di headlines afta im storm out of di post match press conference sake of im feel say di referee decide di outcome of di game.

Ghana vs Central African Republic - Figure 5
Photo BBC News

Di coach wey vex at di time tok say “Ghana go suffer for di 2023 Afcon - e go dey like dia 2021 Afcon.”

Ghana in fact go di Afcon for Ivory Coast wey dem go struggle well well - dem comot from di group stage without a win.

One journalist ask coach Savoy say make im clarify dat statement for di Sunday press conference wey im tok say wetin im tok at di time don happun.

“I tok wetin I tok, na so Ghana struggle for di Afcon, no be so?”.

But for di Monday game, coach Savoy dis game na revenge.

“Eight months be long time for football, but since we play di blackstars tins don change, Ghana gatz new coach, some of di players don change but for us, dis na revenge game.”

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Coach Raoul Savoy im team dey unbeaten for dia last four games wia dem concede only one goal

Ghana vs CAR team news

Coach Otto tok say some of im players get minor injuries for di Mali game especially as di temperature for Bamako during di game na 42 degrees.

“Few players gat small injuries for dat tough game but everibodi don train wey dem go dey ready for di match.”

Im stress say for dis kind games, your bench gatz to be solid to help di team for crucial times.

“Di subs for di Mali game don change di game wey dem win di three points for us. So dat be how we go try to do am going forward,” coach Addo explain.

Central African Republic coach tok say im gatz some young players wey join di team from top clubs for Europe.

Im dey count on dia talent and experience to shock Ghana for dis game.

Im go get any fresh injury wahala for camp, wia im dey confident say dis current form go give dem confidence.

Im tok say “if I no dey confident as di coach, wetin di players go do, so I for dey confident say my team go scatter Ghana blackstars.”

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Otto Addo dey count on di home support for Kumasi to beat CAR

Ghana vs CAR head-to-head

Ghana don play CAR for di 2024 Afcon qualifiers wey Blackstars win 2-1 wit goals from Kudus and Ernest Nuamah for September last year.

For di earlier game for CAR, Ghana secure 1-1 draw away.

CAR for di last two meetings wit Ghana no get win.

Dem lose one, wia dem draw di oda one.

Raoul Savoy’s team don dey excellent form recently wia dem dey unbeaten in four games.

For dat four games, dem score 12 goals wey dem concede only one wit three clean sheets in a row.

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, CAR no get any fresh injury wahala as coach Savoy push for revenge for Kumasi

Possible line-ups

Ghana: Ati-Zigi (GK); Lamptey, Djiku, Salisu, Mensah, Owusu, Partey, Nuamah, Kudus, Jordan, Semenyo

CAR: Youfeigane (GK); Ndobe, Yangao, Niamthe, Guinari, Youga, Toropite, Pirioua, Namnganda, Mafouta, Manzoki

Di match go start at 07:00 Ghana time.