France sama Portugal 5-3 on penalties to qualify for Euro 2024 semi-final

Wia dis foto come from, Getty Images

France - Figure 1
Photo BBC News
Wetin we call dis foto, France qualify for di Semifinal afta dem sama Portugal 5-3 for penalties

5 July 2024, 15:35 WAT

New Informate one hour wey don pass

France don progress to di semifinal of di Euro 2024 tournament afta dem beat Portugal 5-3 for penalties.

Di game travel di full 90 minutes wit extra time but none of di teams fit grab di goal despite say dem create chances.

Di two goalkeepers make plenti saves to keep dia team inside di game wia both teams also get last minute chances for regulation and extra time to win di game.

Kylian Mbappe despite im nose injury play well until coach Didier Deschamps don replace am for extra time sake of im get knock for im face wey already get nose injury.

Demebele comot di bench wey im create plenti chances but France neva fit to capitalize, na so Kolo Muani don repeat di miss wey im get for di 2022 world cup final against Argentina.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Di striker dey thru on goal, wey im wait for di ball to bounce for im front bifor im take di shot wey im deflect go corner.

For Portugal substitutes Conceicao and Semedo enta di game wia dem cause France plenti wahala.

In di end, none of di teams fit grab di winning goal, na so penalties take decide.

France score all dia five penalties - wit Theo Hernandez grabbing di winning goal.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pepe wia chop 41 years and Ronaldo wey be 39 years fit retire from di national team afta dis tournament

Portugal player Joao Felix wia enta di game for extra time don miss im penalty.

Afta di game, Cristiano Ronaldo and Pepe wia dia combine age na 80 years don dey cry - dis fit be dia last tournament wit di national team.

Na so France take win 5-3. France go now face Spain for di semifinal afta dem sama Germany 2-1 for extra time in dia quarterfinal game.

Dat game for di semis na anoda blockbuster.

Penalties

France don win di game 5-3 on penalties.

- Theo Hernandez don score for France 5-3

- Mendes don score for Portugal 4-3

- Barcola don score for France 4-2

- Joao Felix don miss for Portugal 3-2

- Kounde don score for France 3-2

- Bernardo Silva don score for Portugal 2-2

- Fofana don score for France 2-1

- Ronaldo don score for Portugal 1-1

- Ousmane Dembele don score for France 1-0

France go take di first kick

FULL TIME!

Na penalties go decide dis game

Referee don blow for end of di extra time.

121" For di oda end, Marcus Thuram gat chance to score but im fluff im lines.

121" Portugal gat chance to win di game but Mendes im shot dey weak wia maignan don save am.

120" Unless sometin happun from dis point, na penalties we go take find winner

119" Matheus Nunes don dey replace Vitinha.

118" France win corner afta Dembele burst into di box wia im try to cross

117" From di corner, players don dey push push diaserf wia referee blow for foul against Portugal.

116" Kante don misplace one pass for midfield wia di ball fall to Conceicao - di substitute don win corner

115" CHAAANCE! Barcola dribble take enta di nox but again, im shot dey wide. Big chance dia.

114" Long ball from Neves to find Semedo go ova.

113" Dembele don dey do all di good work until im try to shoot. Afta beating players inside di box, di PSG man smash im shot wide.

112" France dey try enta di Portugal box but so far dem no fit.

110" OFFSIDE! Ronaldo tink say im gat chance to enta di box but referee don whistle.

108" CHAAAANCE! Joao Felix almost grab di goal, but im header for di back post from one fine Conceicao cros, dey wide.

106" Joao Felix begin dey do sometin wit di ball inside midfield.

105" Second half of extra time don begin wit Portugal already trying to create sometin but Kounde stop di attack

Portugal coach also dey carry Joao Felix enta di game to replace Rafael Leao for di final 15 minutes

Didier Deschamps don remove Mbappe as im dey use ice for im nose - Barcola di PSG player go enta di game.

Referee blow for halftime for extra time. 15 more minutes to take decide who go win dis one - otherwise na penalties we go take determine.

105" Portugal come forward again thru Mendes - im pass di ball to Conceicao. Di substitute now blast im shot ova di bar.

104" Portugal bin possess di ball for di last few seconds wia dem dey pass pass am among diaserf.

102" CHAAANCE! Portugal go close - Conceicao again don create trouble for di France penalty area but Ronaldo or Leao no fit connect wit im cross.

101" Di two substitutes for Portugal - Semedo and Conceicao don carry some energy come give dis portugal team, for France, dia substitutes Thuram and Fofana no affect dis game so far.

100" Tins don slow down small as di first half of extra time don dey end.

99" Some of di legs don taya - but dem gatz to force to see di end of dis game.

97" Anoda chance for France afta di Mbappe one, dis time na marcus Thuram wey blast di ball ova.

96" CHAAAANCE! Dembele carry di ball travel di whole park bifor im pass to Mbappe inside di box to shoot but Pepe block im shot.

95" Portugal dey pepper di french area well well, wit Semedo and Conceicao.

France - Figure 2
Photo BBC News

93" CHAAAANCE! Conceicao do all di good job inside di box bifor im cutback to Ronaldo but di Al Nassr player strike di ball for row z. Everibodi for di Portugal bench tink say na goal be dat.

92" Camavinga don comot di game wia Fofana don replace am

91" Extra time don start wit France trying to get di early advantage

Extra time 30 minutes dey ahead we gatz to play as we continue to search di winner of dis game

FULL TIME!

93" CHAAAANCE! Dembele do all di hard work wia im pass to Mbappe but im weakl effort dey saved by di keeper.

92" Portugal don replace Palhinha wit Ruben Neves.

92" From di corner, Mbappe strike di shot ova di bar.

91" Marcus Thuram beat Pepe to di footrace but instead say im go shoot or pass di ball quick im slow down wia Pepe block am.

90" Kante gat anoda chance in front of di Portugal goal but im shot dey weak.

88" France gat di counter attack - Dembele lay di ball to Kante; im strike from outside di box neva trouble di Portugal keeper

87" If any of dis teams no fit score for di 90 minutes, na extra time we go play to find di winner.

86" Kolo Muani don comot wia Marcus Thuram don enta.

86" Ronaldo play di freekick take waka di wall. Chance dion vanish.

85" Referee give Saliba yellow card afta im hack substitute Conceicao to di floor just in front of di box. Big chance for Portugal from dia.

84" Portugal dey build up slowly bifor Ronaldo try to enta di box but dem tackle am wey im lose di ball

82" Kante do all di good work for center but im cross into di area no find anybody except goalkeeper Costa.

80" Palinha don get yellow card afta im foul on Mbappe wia im go miss Portugal dia next match if dem fit qualify for di semis.

79" Di two portugal subs alreadi begin dey combine for di flanks to cause Framnce wahala. Dem win corner serf, but France clear.

77" As tins dey enta di final 10 minutes - both teams go try to grab di goal wia fit to win di game but as dem dey search di goal, dem gat to protect dia back also.

75" Portugal coach don change Bruno Fernandes and Joao Cancelo, wia im take Nelson Semedo and Francisco Conceicao enta to try and find di goal.

74" Dembele again try to bend di ball into di far corner from distance but di ball always dey rise.

73" Im dribble enta di box once again wia im strike but dem block am.

73" Since Dembele enta di game, im dey create wahala for di left side of di Portugal defence.

71" CHAAAAAAANCE! France gat golden chance wit Camavinga as di ball find am free inside di box but im no fit beat di keeper. Big, big chance!

68" Dembele don enta di game to replace Griezmann as Didier Deschamps try to grab sometin from dis game

67" Di ball fall for di striker inside di box wit only di Portugal keeper for im front, im hit di ball wey beat di keeper but one Portuguese defender put leg for dia wey di ball go wide.

67" CHAAAAANCE! What a miss by Kolo Muani. Dat resemble chance wia im miss against Argentina for di world cup 2022.

66" For di last few minutes na Portugal dey play all di ball wia dem dey create chance upon chance.

64" Vitinha strike di ball, Maignan save am, di defenders no clear di ball, na so Ronaldo almost score wit backflick but di keeper block am.

64" CHAAAANCE! How Portugak no score dis one, na mystery.

63" Cancelo also gat chance to shoot but im effort dey wide.

62" CHAAAANCE! Bruno Fernandes tink say im score afta Cancelo play one fine pass into di box but Maignan save am.

French players including Dembele don dey warm up for di sidelines.

61" From di corner, nothing happun.

60" CHAAANCE! Leao beat Camavinga wit pace take enta di box but bifor im go take dat shot, Camavinga block am for corner.

58" Rafael Leao im cross into di France box bin too hard wia im comot for goalkick.

57" Afta treatment, di France captain dey okay to play

56" Referee don stop di game as Bernado Silva head one ball to hit Mbappe im face mask.

55" Griezmann decide to hold di ball for long wey last minute im pass dey weak.

55" From di corner Portugal try to score but Maignan punch di ball away bifor France start counter.

54" Portugal don win corner as Camavinga bin tackle Ronaldo.

52" Kante enta di box biufor im cutback find Portugal defender - then later Kolo Muani gat di ball inside di area but im nothing comot for dat chance.

51" Mendes don dive inside di French box without any contact from Upamecano. Some players dey receive yellow card for dat kind tin.

50" CHAANCE! Mbappe strike one shot on goal afta good buildup play in front of di Portugal box but Costa save am.

48" France bin dey pour forward but Griezmann slip for floor wey Portugal begin to counter. Camavinga rush go back to win di ball from di Portugal player.

46" Early freekick for portugal afta Camavinga foul Palhinha.

45" Game don begin.

Both teams don dey enta park afta di first half.

HALF TIME!

Referee don blow whistle for halftime.

Both teams gat few chances for di first half wia dem go hope say di second half go create some chances to grab di goal.

45" Vitinha see plenti space behind di France defense wia im play one pass into di channel but Leao no fit meet am.

44" Rafael Leao don run come back to win di ball from Kounde inside di Portugal area, now Cancelo gat di ball, im turn around small bifor releasing di pass.

43" Bruno dey sit for ground afta one foul, im dey hold im face. Afta few seconds im get up for di game to continue.

42" Bruno strike di freekick but im go wide.

41" Chance for Portugal for dangerous area afta Kolo Muani fould Vitinha. Ronaldo to strike dis one.

40" Bernado Silva ping one cross into di area for Leao and Ronaldo but di ball strong too much wey im go pass dia heads.

38" Nobody dey inside di box to connect to one Portugal cross, Kounde decide to begin di attack but di ball wey end up for Mbappe don miss.

36" Right from dat action, France enta di Portugal area. Portugal bin get di most possession (58%).

36" William Saliba don win di ball inside di France box wit Ronaldo for im back.

34" Camavinga pass di ball to im opponent despite say im gat plenty space to find im teammate.

33" France slowly pass pass di ball take enta di box for Griezmann but bifor im gio set and shoot, Bruno don clear am for corner.

32" Di game don begin dey ginger as both teams try to begin quick counter attacks whenever dem get di ball.

30" Pepe defend one big chance against Kolo Muani. Di striker gat di ball inside di box, instead say im go shoot, im decide to dribble - na so Pepe come block am.

29" Rafael Leao beat Kounde again for di edge of di box bifor goalkeeper Maignan save im shot for di near post.

28" Portugal block Griezmann im shot, di ball fall to Camavinga wia im too im shoot but dem block dat also.

28" Mbappe win di footrace wit Mendes for di Portugal area bifor im cut di ball back to Griezmann.

27" Leao beat Kounde for di edge of di box wey im enta di box, im try to cross di ball but Kounde don block am for corner.

26" OFFSIDE! Referee blow whistle for offside against Mbappe.

25" Griezmann hit di freekick but di danger still dey afta Camavinga pick up di lose ball.

25" France get chance for di left side of di Portugal area afta Pepe hack down Camavinga.

24" Ronaldo dey for ground afta im den Theo Hernandez battle for di ball.

23" Camavinga gatz di ball in front of di Portugal box, instead say im go lay di ball to im teammate, im decide to cross wia di ball go ova.

22" CHAAANCE! Mbappe wit im quick feet dribble past Cancelo inside di Portugal box bifor im hit one shot for tight angle, but Costa save am.

20" CHANCE! Theo Hernadez strike one shot from outside di box afta France pour forward - but Costa save di shot.

20" Portugal wit anoda corner. Fernades strike am but France now dey on di counter.

19" Portugal dey pepper France for di last few seconds. Dem try drive forward on di counter wit Leao, but di final ball no find Bernado Silva.

17" From di corner, Ronaldo try to meet di ball wit im head but France defend.

16" CHAAAANCE! Bruno Fernandes strike one shot from distance afta di ball fall to am. Kolo Muani try to give am pressure but di Manchester United captain still strike di ball.

15" France keeper make mistake for back as im misjudge one backpass, im touch carry di ball go corner

14" One long cross for Leao don dey far - Upamecano take body protect di ball wia im go throw

14" Slow buildup for Portugal now for di back as di players don dey pass pass di ball among diaserf.

12" France tink say dem win corner but di ball touch Mbappe last bifor im go beyond di line.

11" CHAAANCE! Leao take di back of im boot give pass to Mendes but di defender im cross-shot go wide.

10" Bruno strike di corner into di area but anoda clearance carry di ball go midfield wia Mendes don carry come forward.

9" From di free-kick, Bruno try to find Leao but Kounde block di ball for corner

8" Afta dat ball, Portugal try to attack again, but Bruno Fernandes don win free-kick for di right hand corner of di France box

8" Rafael Leao beat im man wia im pass to Mendes wey don dey overlap but im cross into di area hit one french player wey im go throw

7" Portugal try to go forward but France cut out dia ball into di area.

6" Portugal wit possession now. Pepe, di oldest player for di Euros bin dey play passes wit Diaz and Mendes for back.

5" Di match dey settle now as both teams dey fit spray some passes for center.

4" Di first time Portugal begin to create sometin, e happun for Rafael Leao im side.

3" Between Kante, Kounde, Tchouameni dem don dey try to create sometin for France.

2" Early chance for France - Kante try to cut di ball into di Portugal box but dem clear am.

1" France don begin di game on di front foot wit plenti passes inside di portugal area.

1' Referee don blow whistle for match to start