D-Day 80th anniversary celebrations in fotos and why France ...

23 days ago

Wia dis foto come from, Aaron Chown/PA

Wetin we call dis foto, Di Royal Marines of 47 Commando beach bin land for Asnelles bifor e go di Port-en-Bessin for Normandy

6 June 2024, 16:44 WAT

France - Figure 1
Photo BBC News

New Informate 25 minutes wey don pass

UK and France dey organise events to mark di 80th anniversary of di Allied invasion of France.

On 6 June 1944, tens of thousands of sojas bin land on five beaches for Normandy, northern France.

Dis na di largest amphibious invasion for di history of warfare, e play crucial role for di defeat of Nazi Germany and di liberation of Europe.

France - Figure 2
Photo BBC News

Wia dis foto come from, Win McNamee/Getty Images

Sixth of June na date wey dey di memories of generations as D-Day, wen mainly US, British and Canadian forces join hand to defeat Germany.

Wia dis foto come from, Aaron Chown/PA

Wia dis foto come from, Aaron Chown/PA

France - Figure 3
Photo BBC News

For Gold Beach for Arromanches, Normandy, Major Trevor Macey-Lillie, wey be piper wit di Scottish gunners, Perform one time-honoured tradition of playing Scottish lament on di bagpipes.

Di tradition bin recreate di exact moment thousands of British troops disembark for French beaches.

Wia dis foto come from, Aaron Chown/PA

France - Figure 4
Photo BBC News

Wia dis foto come from, Aaron Chown/PA

Pipo bin gada early to attend di event for Gold Beach.

Later on, Prime Minister Rishi Sunak bin speak for UK commemorative event for di British Normandy Memorial for Ver-sur-Mer.

Wia dis foto come from, Jane Barlow/PA

Wia dis foto come from, Gareth Fuller/PA

France - Figure 5
Photo BBC News

"80 years ago, di weather break," im tok, as im begin im address, "and di greatest invasion force for history bin leave di shores of Britain to liberate Europe."

Oga Sunak go on to say we "pledge say we no go ever forget" wetin pipo bin sacrifice for D-Day landings, im add say veterans bin dedicate dia lives to tell odas wetin happun.

Wia dis foto come from, GARETH FULLER/AFP

France - Figure 6
Photo BBC News

British cadets and French primary schoolchildren welcome King Charles III and Queen Camilla as dem arrive for di Royal British Legion commemorative event.

Dem join a number of Western leaders, including US President Joe Biden and French President Emmanuel Macron, to mark di 80th anniversary of di D-Day landings.

Wia dis foto come from, Jane Barlow/PA

France - Figure 7
Photo BBC News

Wia dis foto come from, Jane Barlow/PA

Wia dis foto come from, LUDOVIC MARIN/AFP

Di King bin address veterans for di British Normandy Memorial for Ver-sur-Mer, e say allies bin face di "supreme test" 80 years ago and we dey fortunate say di D-Day generation no shake wen "di time come to face dat test".

France - Figure 8
Photo BBC News

Wia dis foto come from, Gareth Fuller/PA

For di first time di memorial, get di names of di 22,442 servicemen and women under British command wey bin fall on D-Day and during di Battle of Normandy for di summer of 1944, since dem open am for 2021 dem dey use am for major anniversary commemorations.

Wia dis foto come from, LUDOVIC MARIN/AFP

France - Figure 9
Photo BBC News

King Charles III bin lay wreath for di British Normandy Memorial, wit one note wey im attach wey touch on di sacrifices wey dem make on D-Day.

French President Macron and Prime Minister Rishi Sunak follow, dem lay wreaths for di event to mark di anniversary.

Wia dis foto come from, Chris Jackson/Getty Images

Di Red Arrows, alongside one Eurofighter EF-200 Typhoon, do flypast.

France - Figure 10
Photo BBC News

Wia dis foto come from, James Veysey/REX/Shutterstock

Wia dis foto come from, LUDOVIC MARIN/POOL/AFP

President Macron award 104-year-old British World War II veteran, Christian Lamb, di insignia of Knight in di Legion of Honour.

Wren officer Christian Lamb, one veteran officer for di Women Royal Naval Service, na im help plan di D-Day landings from Winston Churchill secret war rooms for London.

France - Figure 11
Photo BBC News

Wia dis foto come from, Jordan Pettitt/Getty Images

Di Prince of Wales bin attend di Canadian commemorative ceremony to mark di 80th anniversary of D-Day, for Juno Beach Centre for Courseulles-sur-Mer.

Canadian Prime Minister Justin Trudeau and France Prime Minister Gabriel Attal greet Prince William.

Wia dis foto come from, LOU BENOIST/AFP

France - Figure 12
Photo BBC News

Di Prince thank Canadian veterans for dia "extraordinary acts of bravery and sacrifice".

"We continue to honour every Canadian, wey bin give so much, every Canadian family wey lose dia loved one," im tok.

Wia dis foto come from, LOU BENOIST/EPA

Im ended im speech for French say: "Thank you for our freedom, and thank you for your service."

France - Figure 13
Photo BBC News

Wia dis foto come from, CHRISTOPHE PETIT TESSON/EPA

Canadian veteran Jim Spenst bin speak to oda veterans before di commemorative ceremony for di Canadian cemetery, wey bin include a descent by Canadian paratroopers near di village of Courseulles-sur-Mer.

Wia dis foto come from, LOU BENOIST/REUTERS

France - Figure 14
Photo BBC News

Wia dis foto come from, CHRISTOPHE PETIT TESSON/EPA

Wia dis foto come from, Elizabeth Frantz/REUTERS

Wia dis foto come from, SAUL LOEB/AFP

Wia dis foto come from, 5 Elizabeth Frantz/REUTERS

US President and First Lady Jill Biden bin meet World War Two veterans for di Normandy American Cemetery for Colleville-Sur-Mer.

France - Figure 15
Photo BBC News

Military fly-past bin greet dem as dem arrive for di D-Day memorial ceremony for Omaha Beach, wit French President Emmanuel Macron and im wife Brigitte.

Wia dis foto come from, Elizabeth Frantz/REUTERS

Wia dis foto come from, Benoit Tessier/ REUTERS

Dem bin hand di Légion d’honneur, France highest medal of honour, to surviving veterans, ahead of President Biden speech.

France - Figure 16
Photo BBC News

Wia dis foto come from, SAUL LOEB/AFP

Wia dis foto come from, Benoit Tessier/AFP

Following di address from US Secretary of Defense Lloyd Austin, President Biden speak of di climate wey bin lead-up to D-Day, and im remember di millions of Jewish pipo wey die for Holocaust, and di millions of odas wey die for di "bloody warfare".

France - Figure 17
Photo BBC News

E say: "On behalf of di American pipo, na di highest honour to salute una for Normandy once again. God love una."

Wia dis foto come from, Benoit Tessier/ REUTERS

Wia dis foto come from, SAUL LOEB/AFP

Oga Biden thank di forces wey "do dia duty" on D-Day - and im ask di audience whether dem go do di same in our "hour of trial".

France - Figure 18
Photo BBC News

Im end to say modern nations must dey "worthy of dia sacrifice" in order to honour those wey bin fight and die.

France - Figure 19
Photo BBC News
Read more
Similar news