Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Cape Verde/Mauritania

Cape Verde - Figure 1
Photo BBC News

29 January 2024, 16:20 WAT

New Informate 3 minutes wey don pass

First Half

35' Substitution! Omare Gassama of Mauritania don comot sake of injury, Guessouma Fofana don replace am.

35' Deroy Duarte of Cape Verde no succeed from im long-range effort afta im collect one pass den fire beta shot. Im attempt to surprise di goalkeeper no work.

31' Di ball dey out of play. Cape Verde get throw-in.

30' Referee Mohamed Adel stop di game. One of di players from Mauritania win di ball, but im effort no sweet di Ref.

29' Bebe of Cape Verde dey worry Mauritania o, e deliver one beta cross into di penalty area, but di opposition defender clear di danger.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

27' Cape Verde get corner kick but defender Babacar Niasse of Mauritania block am.

26' Di ball from di corner kick land for Bebe of Cape Verde leg just outside di box, im fire di shot. Di strike go low towards di left post, but e deflect comot as Mauritania defenders block am.

26' Notin come out from di corner kick wey Cape Verde play, Mauritania defenders block am.

25' Bebe of Cape Verde try to cross di ball but Mauritania players clear am. Di ball don go out of play and di linesman say na corner to Cape Verde.

25' Cape Verde sdon dey get balance for di ball as dem hold ball possession. Dem dey wait for di right moment to create new attacking opportunities.

22' Bebe of Cape Verde shoot from di free kick spot towards di goal, but di ball fly go wide off di right post.

22' Referee Mohamed Adel blows im whistle for a foul afta Ibrahima Keita of Mauritania bring down one of im opponents. Cape Verde get free kick.

21'Aboubakary Koita of Mauritania attempts to slip di ball thru di defence, but im no find any of im teammates. Di ball goes out of play and Cape Verde get goal kick.

18' Cape Verde players dey play combine football as dem dey attempt to create opportunity to score goal.

15' Bodda Mouhsine of Mauritania shoot di ball from di mid-range free kick, but im effort go wide off di right post.

14' One of di Cape Verde players tackle im opponent and concede foul wey give free kick to Mauritania.

11' Kevin Lenini of Cape Verde don collect yellow card sake of one yeye tackle.

10' Ryan Mendes of Cape Verde bin dey close! Im collect pass for di edge of di box , im shoot am but di ball go inches wide off di right post. Di ball go out of play and Mauritania get goal kick.

8' Sidi Bouna Amar of Mauritania attempt to pick out im teammate wey dey free inside di box, but Vozinha comes off di line to clear di ball away.

7' See beta team play from Cape Verde as dem control di ball wit plenti short short passes. Dem dey try find space inbetween Mauritania defence to score.

4' Cape Verde no score from di corner as Babacar Niasse of Mauritania jump to collect di ball.

4' Steven Moreira of Cape Verde weave im way thru di opponents and strike di ball from di edge of di area, but Mauritania defender. block am. Cape Verde force dia opponents to concede corner kick.

1' Referee don blow whistle and di match don start

Cape Verde go face Mauritania for di knock out stage of di 2023 Africa Cup of nations (Afcon).

Di match go happun for di Abidjan’s Félix Houphouët Boigny stadium on Monday 29 January, 2023.

Pipo eyes dey well well for di round of 16 clash between Cape Verde and Mauritania sake of say di two teams wey pipo bin tag ‘underdogs’ (small teams) shock evribodi for di group stage.

For Mauritania, dis na dia first-ever 2023 Afcon win and e give dem dia first knockout spot.

Mauritania na one of di best losers wey also be third-placed qualifier. And dem manage qualify for di Round of 16 afta dem win Algeria.

For di Blue Sharks of Cape Verde, dem dey in excellent form as dem finish ontop Group B wey get big names like Ghana and Egypt and Mozambique.

Cape Verde beat Ghana and Mozambique, and play draw wit Egypt. Cape Verde beat Ghana and Mozambique, and play draw wit Egypt. E mean say dem enta dis round unbeaten.

Line -Ups

Cape Verde starting 11: Josimar Dias, Roberto Lopes, Logan Costa, Jovane Cabral, Joao Fernandes, Jamilo Alvarenga, Deroy Duarte, Ryan Mendes, Thiago Correia, Steven Moreira, Kevin Pina

Mauritania starting 11: Niasse Barbacar, Diaw Khadim, Omare Gassama, Ba Lamine, Bodda Mouhsine, Hemeya Tanji, Anne Souleymane, AboubakaryKoita, Keita Ibrahima, El Hassen, Sidi Amar