Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Foto of Ademola Lookman/Chiamaka Nnadozie

16 December 2024

CAF Awards 2024 - Figure 1
Photo BBC News

Nigeria and Atalanta of Italy forward, Ademola Lookman don win di Africa Best Player of di Year Award for 2024.

Di 27 years old Nigeria beat strong competitions from Cote d'Ivoire and Brighton & Hove Albion winger Simon Adingra.

Odas wey im beat na Borussia Dortmund and Guinea international striker Serhou Guirassy, Morocco right-back Achraf Hakimi wey dey play for Paris Saint-Germain, and Mamelodi Sundowns goalkeeper Ronwen Williams of South Africa.

Lookman bin hot well-well dis period as im dey for im best form dis 2024. Im help turn im Italian Serie A club Atalanta into title contenders and help dem win di UEFA Europa League trophy.

Dis na dia first major trophy for di club for 61 years.

Lookman bin score hat-trick for di final as Atalanta becom di only team for di 2023-24 campaign to beat German Bundesliga outfit Bayer Leverkusen.

Lookman play one of di finest football as im provide one of di great final displays for European football history.

Lookman also help Nigeria reach di final of di Africa Cup of Nations, Cote d'Ivoire 2023, wia dem lose to di hosts.

Im play beta football, score three goals, and dem also name am for di Team of di Tournament. Ballon d'Or nominee Lookman dey hunt for greatness.

Skip Twitter post

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post

Chiamaka Nnadozie win women goalkeeper of di year

Chiamaka Nnadozie of Nigeria also retain her title as di women best goalkeeper for Africa.

Di safest hands for Nigeria women football team, Super Falcons, beat Khadija Er-Rmichi of Morocco and AS FAR and Andile Dlamini of South Africa and Mamelodi Sundowns to win di award di second time back to back.

Di Super Falcons of Nigeria also win di National Team of di Year Award.

Oda players like Osinachi Ohale, Asisat Oshoala and Rasheedat Ajibade make di Caf Best 11 for women.

Wetin be Caf Awards

Di awards na to showcase and recognise players and pipo wey dey outstanding for African football.

E dey also celebrate di best talent for African football, as e honour players, coaches and teams, both male and female, in different categories.

Football fans around di world dey always wait for dis exciting moment to see which players go win di awards.

Di Confederation of African Football don dey organise dis event since 1992.

Full list of winners

Player of di Year Men - Ademola Lookman (Nigeria)

Player of di Year Women - Barbara Banda (Zambia)

Goal of di Year - Mabululu (Angola)

Coach of di Year Men - Emersae Fae (Cote d'ivoire)

Coach of di Year Women - Lamia Boumendi (TP Mazembe, Congo)

Goalkeeper of di Year Men - Ronwen Williams (South Africa & Mamelodi Sundowns)

Goalkeeper of di Year Women - Chiamaka Nnadozie (Nigeria, Paris FC)

Interclub Player of di Year Women - Sanaa Mssoudy (ASFAR, Morocco)

Interclub Player of di Year Men - Ronwen Williams (Mamelodi Sundowns, South Africa)

Club of di Year Men - Al Ahly (Egypt)

Club of di Year Women - TP Mazembe

National Team of di Year Men - Cote d'Ivoire

National Team of di Year Women - Nigeria

Young Player of di Year Men - Lamine Camara (Senegal)

Young Player of di Year Award Women - Doha El Madani (Morocco)

Past five winners

Di last past five winners na:

2023: Victor Osimhen, Nigeria - Napoli (ITA)

2022: Sadio Mané, Senegal - Liverpool (ENG)

2021: Not awarded

2020: Not awarded

2019: Sadio Mané, Senegal - Liverpool (ENG)

2018: Mohamed Salah, Egypt - Liverpool (ENG)

2017: Mohamed Salah, Egypt - Liverpool (ENG)