Nigeria vs South Africa highlights: Rasheedat Ajibade goal put ...

26 days ago

Nigeria beat South Africa to keep Paris 2024 Olympics dream alive

Wia dis foto come from, Super Falcons/Twitter

Banyana Banyana vs Nigeria - Figure 1
Photo BBC News

5 April 2024, 15:20 WAT

New Informate one hour wey don pass

Second Half

Full Time Nigeria 1-0 South Africa

94' Match don end

90' Referee add 4 minutes before e blow whistle.

88' Na few minutes remain for di match to end but anytin fit still happun di two kontris no wan gree for eachoda. South Africa dey find equalizer while Nigeria don tight di defence.

85' Nigeria 1-0 South Africa

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

80' Nigeria and South Africa still dey struggle for pitch for di few minutes wey remain.

71' Players go on water break for second half

70 ' Substitution for South Africa

66' Substitution for Nigeria, Jennifer Echegine don comot for Toni Payne while Esther Okoronkwo enta for Chinwendu Ihezuo

63' Yellow card for South Africa player Seopesenwe afta she murmur for one of di Assistant referees.

62' Corner kick for Nigeria, Rasheedat Ajibade take am afta one-two touches e enta di hand of South Africa goalkeeper Swart.

55' Chiamaka Nnadozie save one goal attempt as she stop Seopesenwe ball from far.

53' South Africa collect ball from Nigeria leg from di midfield, Nigeria collect di ball back but Chiwendu Ihezuo miss anoda beta chance to score. Dem try again but goalkeeper Stwart catch di ball easily.

52' Missed chance! Nigeria get beta chance to double dia lead but dem play am over di goal post.

51' South Africa goalkeeper Stwart dey very busy sake of say Super Falcons no dey give her breathing space.

48' Nigeria comeback into di game wit full ball control, dem just dey play short short passes until dem attempt goal but South Africa goalkeeper Stwart catch di attempt witout stress.

46' Second half don start

First Half

45mins: HALF TIME

Nigeria 1-0 South Africa

43' Goal! Rasheedat Ajibade score from di spot for Nigeria

41' Penalty for Nigeria

39' Nigeria get anoda corner kick but e enta South Africans leg, dey try to make sometin from am but e no work, e run cross Nigeria goal post.

Nigeria 0-0 South Africa

35' Missed chance! Nigeria miss beta opportunity to take di lead afta Chiwendi Ihezuo miss beta chance to slot di ball inside di empty net one on one wit goalkeeper from di side.

33' Nigeria dey dominate di midfield for di last three minutes as dem dey disturb di South African defence.

30' Nigeria get corner kick and Rasheedat Ajibade play am but di South African defence clear di ball.

27' Di girls go on water break afta referee blow whistle to signal time for water break

Nigeria 0-0 South Africa

25' South Africa don begin enta di game, dem control one ball from midfield to Nigeria goal area but dem play an go right corner of di goal post.

24' Nigeria get freekick and na Rasheedat Ajibade wey dey captain di team play am.

20' South Africa bin near Nigeria goal but Chiamaka Nnadozie catch di ball.

17' Deborah Abiodun make goal attempt but e land for South Afrtica goalkeeper Swart hand.

15' Uchenna Kanu and Deborah Abiodun dey worry South Africa.

10' Nigeria Super Falcons no dey give South Africa any chance to play ball.

7' Uchenna Kanu make two goal attempts back to back but South Africa goalkeeper save am

4' Nigeria dey put pressure on South Africa but goal neva enter yet.

Nigeria 0-0 South Africa

1' - KICK OFF

Nigeria Women National team, di Super Falcons go face Bayana Bayana of South Africa for di first leg of di last round of di 2024 Olympic qualifiers.

Di match go shele for di Moshood Abiola National Stadium Abuja, Nigeria capital on Friday evening.

Di two teams don arrive Nigeria since, dem don train well well as both teams dey expect positive results.

Head Coach of Nigeria Super Falcons, Randy Waldrum say im don tok to di players one by one and im believe say dem know wetin dey at stake for dis match.

"Dem understand di job wey dey dia front, wetin me and my coaching crew dey do na to make sure say dem understand di game plan so we fit get di best opportunity to succeed."

Head Coach of South Africa Desiree Ellis sef dey prepare to win dis match so dat e go easy for dem for di return leg.

Even though Nigeria Super Falcons neva qualify for Olympics since 2008 dem still be di most successful team for Africa and dem reach di knockout stage for di Women's World Cup.

Banyana Banyana wey be di reigning champions of di Women Africa Cup of Nations na big threat following dia performance for di Fifa Women World Cup as dem reach di Round of 16 for Australia and New Zealand last year.

Line ups

Nigeria starting 11: Chiamaka Nnadozie, Osinachi Ohale, Michelle Alozie, Chidinma Okeke, Christy Ucheibe, Jennifer Echegini, Deborah Abiodun, Halimatu Ayinde, Rasheedat Ajibade, Uchenna Kanu, Chinwendu Ihezuo

South Africa starting 11: Kaylin Swart, Bongeka Gamede, Matlou Noko, Seoponsenwe, Dhlamin Karabo, Makhubela, Hildah Magaia, Mothlhalo, Jane, Ramalepe Lebohang Kgatlana,

Dey refresh dis page for live updates of di match

Read more
Similar news
This week's most popular news